13 pipo wey dia deaths shake di world for 2023

13 pipo wey dia deaths shake di world for 2023

2023 na di year wey Nigeria lose plenti celebs dem, most especially for di movie industry.

For di music industry, Nigeria bin get dia most controversial death in recent times.

Di death shock pipo and make authorities call for investigation into di death.

BBC Pidgin take a look at some of di deaths wey shake not just Nigeria, Africa and di world for 2023.

Mohbad

On di 12th of September na im one of di most notable death tori of di year break as di management of Mohbad wey im papa name Ilerioluwa Oladimeji announce for im Twitter page say im don die.

Tori start to go round say Mohbad die on top mysterious circumstances as videos dem start to dey comot of how e suffer harrassment and bullying wen e bin dey alive.

Police investigation into di mata make dem arrest five pipo wey include musician Naira Marley wey be Mohbad record oga before and Sam Larry.

Di two bin later dey released on bail, howeva, police tok say di prime suspect to Mohbad death na di nurse wey give am injection shortly before im death.

Murphy Afolabi

On di 14th May, Nollywood actor, Murphy Alabi die one week afta im 49th birthday.

Murphy Afolabi na popular actor, director producer. E dey popular for Yoruba feems and don feature for plenty movies wey include Okiki Oru, Blackout, Queen Lateefah, Four Lions, One Blood, among odas.

Peace Anyiam-Osigwe

For di beginning of di year, movie producer, Peace Anyiam-Osigwe bin die, according to statement wey her family release.

Dem born Peace Anyiam-Osigwe, wey previously be Peace Anyiam-Fiberesima MFR for 30 March.

She be ogbonge Nigerian filmmaker and entertainment executive wey pipo dey call "di queen of Nollywood films".

She be di founder of globa feem ceremony, Africa Movie Academy Awards, AMAA.

Na Ms Peace direct di first music video of hip-hop star, P-Square.

For 2012, she bin dey honoured as Member of di Order of di Federal Republic by di Nigerian goment.

Chief Ojo Arowosafe (Fadeyi Oloro)

On di di 7th of March, ogbonge Nigerian actor Ojo Arowosafe aka Fadeyi Oloro die at di age of 66 afta im battle wit sickness.

Fadeyi Oloro character for movie na herbalist and warrior wey pipo dey always fear. Di roles make di actor reign for di 80s, 90s and early 2000s. Many pipo wey dey act dis kind roles for movies usually get pesin wey dey teach dem, but nobody teach Fadeyi Oloro wetin im sabi, according to di ogbonge actor for one interview.

According to di actor, na di knowledge wey God give am im dey use for wetin im dey do and na since wen im dey small im don dey do am.

Despite di roles wey im dey play for movies, Fadeyi Oloro na good Christian and pastor. Di veteran actor say di roles wey im dey play for movies no mean say im be bad pesin.

Obinna Nwafor (Saint Obi)

Nollywood ogbonge actor, Obinna Nwafor, wey dey known with im stage name Saint Obi die for May.

E bin dey as one of di main players wey start di Nollywood industry for Nigeria.

E no clear how many feems e don act for im long career wey start 28 years ago.

Later, e stop to dey act and start im own company wey suppose dey train young actors wey wan enta di industry.

Di accolades wey im don collect in terms of awards include:

  • Best Actor in Nigeria - African Movie Academy Awards

  • Best Actor in Africa - Africa Magic Viewers Choice Awards

  • Best Actor in Nigeria - City People Entertainment Award

  • Best Actor - Nollywood Movie Awards

Cynthia Okereke

For 12 July, Nollywood actress Cynthia Okereke die at 63 years old afta wetin her family bin tell BBC say na "brief illness".

Some of di feems wey she act include di 2003 feem wey bin popular well-well, Osuofia in London and di part 2 of Osuofia in London (2004), Wisdom of the Gods, Chibundu, Woman on Top, North and South,

She also act A Fool At 40 for 2004. Oda movies she act na Reggae Boys, Nwando, The God to Serve, Where Oceans Touch part 1 and 2,

Before her death, she add value to di Nigeria entertainment industry as she dey act both English and Igbo feems.

AKA

On 10 February, South African rapper Kiernan Jarryd Forbes, wey pipo sabi as AKA bin die for shooting incident as e dey comoy restaurant.

AKA death come about two years afta di tragic death of im fiancée Anele Tembe.

AKA na popular award winning South African rapper wey pipo sabi beyond di continent.

Forbes become popular afta releasing im single "Victory Lap" from im debut studio album, Altar Ego for 2010. Since den, e don go on to release oda songs wey bang like, All Eyes on Me for 2014, Fela in Versace for 2018 and Lemons for 2022.

AKA get one daughter, Kairo Forbes with im former partner, DJ Zinhle.

Zahara

Zahara

Na 11 December, wen, ogbonge South African musician, Bulewa Mkutukana wey pipo sabi as Zahara die for inside hospital.

Di singer win fame for 2011 wit her album Loliwe, and for 2019, Zahara bin open up about her battle wit alcohol addiction.

Zahara, wey release five albums, win dozens of awards both local and international.

For 2020, dem name her for di BBC 100 Women list.

Di songwriter dey also use her platform to speak out about violence against women for South Africa, sometin she reveal say bin happun to her.

Christian Atsu

Christian Atsu

For February, Turkey face some of im most ogbonge earthquakes ever wey affect neighbourhood kontri Syria wey kill Ghanaian international player Christian Atsu.

Dem find im bodi days afta di incident.

Atsu be Ghanaian international player wey play professional football for Turkish Super Lig until e meet im untimely death inside earthquake.

Born 10 January 1992, de Ghanaian professional footballer play for Hatayspor since September 2022.

E bin get three kids plus im wife.

Sinéad O'Connor

Sinéad O'Connor

For July, Irish singer and activist Sinéad O'Connor die at di age of 56.

Her most successful single na her 1990 cover of di Prince song Nothing Compares 2 U.

E top charts around di world and feature for her Grammy-winning album I Do Not Want What I Haven't Got.

She bin get a up and down childhood and dem later diagnose her with bi-polar disorder and she speak openly about her struggles with her mental health

O'Connor bin dey outspoken on subjects ranging from religion to women's rights and racism

Jerry Springer

Jerry Springer

Jerry Springer, best known for im ogbonge TV talk shows, die peacefully for im house for April at di age of 79.

Di controversial presenter bin host di The Jerry Springer Show for almost three decades from 1991.

Dem sabi di talk show host for im Jerry Springer show, wey run in di US from 1991 until 2018.

Before im enter di TV industry, Springer bin do different tins plus im career as a political reporter and commentator, to serving as di mayor of Cincinnati for Ohio and as a political campaign adviser to Robert F Kennedy.

Tina Turner

Tina Turner

For May, ogbonge American singer Tina Turner, die at di age of 83.

Turner bin suffer a number of health issues in recent years wey include cancer, stroke and kidney failure.

Some of di songs wey make am blow na soul classics songs and pop hits like, The Best and What's Love Got to Do With It.

She bin rise to fame alongside her husband Ike, for di 1960s wit songs wey include Proud Mary and River Deep, Mountain High.

She divorce di abusive Ike for 1978, and go on to find even greater success as a solo artist for di 1980s.

Moonbin

Moonbin

K-pop fans also suffer loss afta 25 year old star Moonbin take im own life for Seoul.

Moonbin bin don work as actor and model before e join di popular boy band Astro for 2016 at di age of 18.

Since 2020, e bin dey perform wit anoda Astro member Sanha inside one collabo.

Moonbin & Sanha bin dey for middle of a world tour wit dia last performance for Bangkok on 8 April.

Comments

Keep up to date with our latest articles and uploads...